Taaooma: I Start Music Because I Wan Use My Own Songs for My Skits

Popular skit maker, Maryam Akpaogaki, wey dem dey call Taaooma, don reveal why e venture into di music industry.


Di comedienne-cum-musician say e start music because e feel sey e go be better to use im own songs for im skits, instead of to dey use songs by oder musicians.

E disclose dis while featuring as guest on di latest episode of The Leaderboard podcast wey Fisayo Fosudo dey host.

E say, "For me, entertainment na freedom. You fit do anything.

"I also like di fact sey na my music. Na my song. Na song wey I fit dey proud say I make am. I just feel like, I dey use oder people's songs [for my skits], and dis thing no hard. I get studio, we fit record songs.

"I love music. Some pipo use to say I get [melodic] voice. But, I feel like, instead of me try to sing, we fit do collaborations and make something happen."

About those wey dey criticize im music, Taaooma say na up to God and im commitment to prove dem wrong.

No comments:

Post a Comment